POLICE COMMAND FOR NIGERIA ARE INVESTIGATING THE DEATH OF ONE 11 YEAR OLD MARGARET JOSHUA AFTER HER MADAM ALLEGEDLY BEAT HER AND INFLICT INJURIES ALL OVA HER BODY
Police Command for Nigeria are investigating the death of one 11-year-old Margaret Joshua afta her madam allegedly beat her and inflict injuries all ova her body.
Di mata come to light afta one good Samaritan, Madam Comfort Moses say she find her dey hide near her house and dem rescue her and carri her go hospital.
She explain to BBC Pidgin say di mata begin on Friday 11 November, 2022. "Na around some minutes to 7:00pm, na im my husband comeback to tell me say im see one girl dey outside and im dey tok to her but she no dey ansa."
Na so Madam Comfort Moses tok as she narrate how she bin discover 11-year-old Margaret Joshua wit injuries all ova her body near her house.
"I go back house but my body no gree me, I get to go outside again to search for her, I still no see her, na di third time wey I go outside to search for her I see her under one building for my house, becos my house dey like upstairs.
She no fit tok she no fit waka. I remove her from wia she dey, cari her go up. I ask her who she be she say her name na Margaret."
"She come tell me say Mummy abeg I go tell you, give me water.”
Before I go enta kitchen go bring water come, she don use her knee crawl go wia tap dey with two plastic container.
Madam Comfort say Margaret no fit sitdown and she get to cari her for lap, make tea for her make she drink, she no fit drink di tea becos she get wound for her mouth.
"I come dip di bread inside di tea dey put am inside her mouth make she swallow.
Afta sometime my husband call me, ask me wetin we go do about di girl? I tell am to call security."
"So before we call security I tell her to tell me di truth of wetin happun, she tell me say she get wound for her bumbum, say she dey live with her aunty wey dey beat her anytime wey dem give her work to do and she no fit do am."

Comments
Post a Comment